Sunday 28th August 2022 Devotion
Scripture:- 1 Kings 21:1-26
Topic:- Laugh Wan Kill Me O
Dem say Boko Haram don poison beans after I buy half bag for house.
From the one wey I cook, I give my Dog, Bingo, make im first test am.
45mins later, Bingo still dey waka, dey jolly.
Na im I come chop my own.
After I don chop finish, my Gateman run come tel me say Bingo don die.
Hey! I run enter house, begin drink full gallon of Palm Oil for my belle.
Chop 22 Bitter Kola wit 3 long Bitter Leaf stem, chop Walnuts with the Shell, no time to crack.
Swallow Moringa with Aloe Vera as treatment combo.
Garlic and Onions be like sweet for my mouth.
I come dey sweat as if na oven be my bedroom.
I dey think say my life don finish. I come outside.
Na him my Gateman come dey tell me say, the Driver wey kill Bingo wan come beg me!
If na you, wetin you go do the Gateman?
Please don’t laugh alone our situations shall end in laughter.
Prayer Point:-
Oh Lord God, I refuse to be stupid in my dealings with people henceforth by fire, in the name of Jesus Christ.
Happy Lord’s Day! www.timogundelejesu.com